Jerry John Rawlings, Ghana longest serving leader don finally enta six feet.
Na for military cemetery in Accra dem bury di late Flight Lieutenant Jerry John Rawlings (retired) on Wednesday afternoon around 4 O’clock Ghana local time (16:00 GMT).
Ghanaians and sympathisers from di UN and African Union, including President of Liberia George Weah and Julius Maada Bio of Sierra Leone show dia final respect to former Ghanaian President Jerry John Rawlings.
Flight Lieutenant Jerry John Rawlings (retired) solemn funeral ceremony earlier hold for Black Star Square inside Accra.


Jerry Rawlings deadi bodi don dey lye in state for three days and hundreds of people demma go pay dia last respects.
De former Ghanaian President die on 12th November 2020 after a short illness, aged 73.
Former Ghana President Jerry John Rawlings initially scheduled funeral for hold December 23, 2020 but goment postpone am, due to what de foreign ministry call “unforeseen circumstances” so dem shift to hold from 24 to 27 January, 2021.

WIA DIS FOTO COME FROM,NIPAH DENNIS

WIA DIS FOTO COME FROM,NIPAH DENNIS
Tribute after tribute pour in for de late Ghanaian leader, describing him as a selfless and committed leader wey work for de common good of im kontri.
Three African presidents, UN, AU, Ghana leaders na im follow show face on Wednesday bury Jerry Rawlings.

WIA DIS FOTO COME FROM,NIPAH DENNIS

WIA DIS FOTO COME FROM,OTHER
Rawlings family, de NDC, Ecowas, di military, among odas, lay nine wreaths for late Ghanaian leader.
During President Akufo-Addo tribute, im announce say de University of Development Studies, Tamale name go change to Jerry John Rawlings University of Development Studies, Tamale.

WIA DIS FOTO COME FROM,OTHER

WIA DIS FOTO COME FROM,NIPAH DENNIS
Na Jerry Rawlings get credit for maintaining Ghana stability and im be lead a military goment for over ten years before returning di west African kontri to multiparty democracy in 1992.
Late Flight Lieutenant Jerry John Rawlings contribute to peace efforts in Liberia and Sierra Leone during di civil wars in di 1990s and most recently im serve as African Union envoy to Somalia.

Rawlings also lead campaigns against Malaria across di African continent.
Ghanaians and many go remember am as a disciplinarian but also as a leader wey care about ordinary people.
Ghana Prez Nana Addo Dankwa Akufo-Addo, di current president of Ghana, im Vice, Speaker of Parliament, former Prez John Mahama and John Kufuor show face on Wednesday for di burial inside Accra.

WIA DIS FOTO COME FROM,OTHER
After Professor John Attah Mills, di Late Flight Lieutenant Jerry John Rawlings be di second Ghanaian former leader of di fourth republic to die and receive state burial since 1992.
Dignitaries from all walks of life attend di burial of de man Ghanaians give make names like Papa J, Junior Jesus, Hero and Legend.

WIA DIS FOTO COME FROM,NIPAH DENNIS

WIA DIS FOTO COME FROM,NIPAH DENNIS
Di military fire 21 one gunshots national salute wit di flags flying at half mast in honour of Late Ghana Prez Jerry John Rawlings as demma lower en casket into mother earth inside di military cemetery Accra, Ghana.
Na de Ghana Air Force lead di burial rites for Late Ghana Prez Jerry John Rawlings, dis na as e be say im rule Ghana as Flight Lieutenant wen im be military leader before di start of di fourth republic for 1992.